New Video: Moses Bliss - Umbrella x Festizie, Chizie, Son, Neeja, Membrane, Doris Joseph, Ajay & Godfrey Gad

 

Gospel singer and songwriter, Moses Bliss has dropped the official video of his song Umbrella, featuring Festizie, Chizie, Son, Neeja, Membrane, Doris Joseph, Ajay & Godfrey Gad.

Enjoy the video below


Lyrics

Because my papa dey in control
I nor fit fail oh
He is more than able oh
Because my daddy dey for him throne
Observe my life oh
See the way e align oh


Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh


Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh


My daddy cover me
Cover cover cover
Give his angels charge over me
Over over over
Dem no fit koba me
Koba koba koba
Odeshi dey for my body

Wetin you see
Wetin you see
For my body
For my body
Wey you dey carry me go
Na you dey carry me go


I dey under the canopy
So I no get wahala
I get no p
When dem try to put am for my body e bounce
Cos Jehovah e cover me (cover me)


Your love no dey stop
E nor get e check point oh
Everything you do is on point oh
Lord na my head wey you anoint oh
Your grace no dey rest
E dey always dey follow me
Your joy be my strength
E dey power me
No other power fit to oppose me


Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh


Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh


Twenty-four seven
You be God
Na you get all power
I dey steady dey collect oh
Cos na your hotspot me I connect oh


If you check am
Oil dey my head
You dey see am wella
Olorun Oba na you set my ladder
Anytime I step inna the place na fire

By the grace of God
The gbedu dey sama
Planted by the waters I nor need mai ruwa
If you know my name
Omo na God dey do am
Amarachukwu jejely dey lift me higher higher

Under your canopy
Papa you cover me
Shey na you wey dey give me ability
I get your backing your agility
From now till eternity
(Till infinity)


My brother my sister
Na baba dey carry the boy go far
Anywhere I enter
Moves monumental
Inside him plans Na me dey for the center


Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh

Because I’m under
I’m under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh


Because my papa dey in control
I nor fit fail oh
He is more than able oh
Because my daddy dey for him throne
Observe my life oh

See the way e align oh

0/Post a Comment/Comments

Previous Post Next Post